Nigerian Pidgin

Di Faith of Saint Joseph

December 18, 2019
Weekday for Advent
Readings for Today

Listen for English

Di angel of di Lord appear to Joseph for dream and talk say, “Joseph, David pikin, no fear to take Mary your wife come your house.  Na through di Holy Spirit she take carry dis Pikin for belle.  She go born one son, and you go name Him Jesus, because He go save His people from dia sins.”  Matthew 1:20b-21

Saint Joseph na man wey we no know plenty things about, but think about how important di role wey he play for di history of salvation be.  God put His Son for Joseph hand as Joseph own small Pikin.  At first, he no understand how Mary take get belle, but after he receive di angel message for dream, he accept dis Pikin as im own and care for Him with papa love.

E dey important to note say Saint Joseph accept di Christ Pikin because of one dream.  But na only dream e be?  All of us dey dream plenty dreams, and some of dem strange and no get meaning.  So why Saint Joseph trust say dis dream na true message?

Di answer to dis question dey simple well-well.  Even though wetin he see na dream, di gift of faith follow di dream come too.  Joseph know for sure, pass wetin human reasoning fit tell am, say na God voice don speak to am, and he respond with faith wey he give with all im heart.

We fit no get dreams where God go speak to us through an angel, but God dey speak to us throughout di day.  He dey speak directly to our minds and hearts, and also, for different-different ways, through di care and work of angels wey nobody fit count, as dem dey act as His messengers.  God angels dey always bring us divine messages and things wey God dey inspire us to do.  Di question be whether we dey listen or we no dey listen.

To listen to God voice through di work of di angels as His messengers no mean say we must see di angels with our eyes or hear dem speak with our ears.  Instead, na to recognise and understand dis language of love wey dem dey speak to us, wey dey call us to faith.  

Today, listen inside di silence of your heart, and allow yourself to follow di glorious example wey Saint Joseph show as he respond to wetin our Lord want with perfect faith and trust.

Lord, I dey long to hear Your sweet voice.  I dey long to know everything wey You command me to do and everything wey You inspire me to accept for life.  Give me di grace wey I need to follow everything wey You inspire me to do for life, so that I fit fulfil Your perfect and holy will.  Jesus, na You I trust.

More Reflections on the Gospel

Reflection Dem about God im Mercy

Material Dem for Advent

Saints/Feasts for Today