Nigerian Pidgin

To Dey Talk Make E Clear

May 23, 2020
Satide for di Sixth Week of Easter
Readings for Today

Listen for English

“I don tell una dis things with figures of speech. Di time dey come when I no go use figures of speech talk to una again, but I go tell una about di Father make e clear.”  John 16:25

Why Jesus dey use “figures of speech” talk instead make E talk make e clear?  Na good question.  

We dey see dis same thing for di plenty parables wey Jesus tell.  E fit be say, when people hear His parables, dem go comot dey ask, “Wetin una think say E mean by dat?”  So why Jesus dey use talk wey di meaning dey hidden instead make E talk straight and make e clear?

Di answer concern us and how we no dey fully open to di Truth.  If we dey fully open to di Truth, and if we dey completely ready to accept di Truth no matter wetin e be, Jesus go fit talk to us make e clear, and we go respond at once.  But na only once once e dey happen like dis.  To understand dis matter, we need to understand di connection between to know wetin God want and to dey willing to do wetin E want at once.

Plenty times, we want make Jesus tell us wetin E want, make we turn am over for mind, think about am, then come back with our answer.  But e no dey happen like dat.  Instead, if we want make Jesus talk to us make e clear, we must tell Am yes even before we know wetin E want.  We must first dey willing to accept wetin E want before we fit understand wetin E want.  

Of course, our Blessed Mother na di perfect example of dis for her fiat.  Before di angel come meet her, she dey always tell God “Yes” to wetin E want.  Then, when di angel come meet her and tell her wetin go happen, she ask make e clear.  And truly, di answer to her question make di matter clear for her.  “Di Holy Spirit go cover you with His shadow, and di power of di Most High go come upon you…” na wetin di angel talk.  But di only reason why di angel, as God’s messenger, talk so clear na because she don already show say her heart dey fully ready to follow God’s plan, no matter wetin di plan go be.

Today, think about how clear you dey hear wetin God dey tell you.  You want make wetin E dey tell you clear pass as e dey now?  You want make E talk to you in a way wey go clear more?  If na so, work on how you go surrender wetin you want more fully to wetin you never even know.  Tell God “Yes” to wetin E go want from you tomorrow, and tell Am dat “Yes” today.  As you dey build dis habit to dey say yes at once, e go open di way make everything wey God want talk clear more for you.

Lord, di answer na “Yes.”  Na wetin You want I choose today, tomorrow and always.  I no choose any other thing apart from wetin You want.  As I dey tell You “Yes,” help me make I dey understand more clearly everything wey You ask of me.  Jesus, na You I trust.

Novena to di Holy Spirit
Wey we dey pray to prepare for Pentecost
Day Two – Satide, May 23

More Reflections on the Gospel

Reflection Dem about God im Mercy

Saints/Feasts for Today

Options for Mass Readings

Picture: Di Encouragement to di Apostles by James Tissot