Nigerian Pidgin

Wen E Show Imself to di World

Sunday, January 3, 2021

Di Lord Im Epiphany—Solemnity
January 6, or di first Sunday after January 1
As dem dey celebrate am for your local diocese or territory

Readings for Today

Listen for English

Wen dem born Jesus for Bethlehem for Judea, for di time wey King Herod dey rule, see, some Magi from di east come reach Jerusalem. Dem ask, “Where di king of di Jews wey dem just born dey? We see Im star as e dey rise, and we don come to honour Am.”   Matthew 2:1–2

E most likely be say di Magi come from Persia, wey dem dey call Iran today. Na men wey dey study stars regularly. Dem no be Jews, but e most likely be say dem know about wetin plenty Jewish people believe: say dem go born one king wey go save dem.

God call these Magi make dem come meet di Saviour of di World. One thing wey stand out be say God use something wey dem sabi well as di means to call dem: di stars. One of di things wey dem believe be say, wen dem born person wey get great importance, one new star go appear with di birth. So wen dem see this new star wey bright and dey shine well, dem really want know more, and hope fill their heart. One of di most important parts of this story be say dem answer di call. God use one star call dem, and dem choose to follow this sign, begin one long journey wey hard well-well.

Many times, God dey use things wey we sabi well, wey be part of our everyday life, to call us. Remember, for example, say many of di Apostles na fishermen, and Jesus use their work call dem, make dem become “people wey dey catch people.” E especially use di miracle wey make dem catch plenty fish to show dem clearly say dem don get new calling.

For our own life, God dey always call us make we seek Am and worship Am. Many times, E go use some of di simplest things for our life to call us. How E dey call you? Which way E dey send you one star make you follow? Plenty times wen God speak, we no dey pay attention to Im voice. We must learn from these Magi and answer with all seriousness wen E call. We must no delay, and every day we must try to pay attention to di ways wey God dey invite us make we trust Am more, surrender ourselves more to Am, and worship Am more.

Today, think deeply about how God dey call you for your life. You dey listen? You dey answer? You ready and willing to leave every other thing for life so you go fit do Im holy will? Seek Am, wait for Am and answer Am. If you do so, na di best decision wey you go ever make.

Lord, I love You, and I pray make I dey open to di way You dey guide my life. Make I always pay attention to di countless ways wey You dey call me every single day. And make I always answer You with all my heart. Jesus, na You I trust.

See our Christmas resources!

Meditations on Scripture

More Reflections on the Gospel

Reflection Dem about God im Mercy

All Saints/Feasts

Saint for Today – Di Lord Im Epiphany—Solemnity

Options for Mass Readings

Di main picture wey dey above: Di Magi, wey Henri Siddons Mowbray paint


Join us for journey of 365 days with Divine Mercy!

Daily Reflections on Divine Mercy: 365 Days with Saint Faustina wey mean Daily Meditation on God Mercy: 365 Days with Saint Faustina, start on January 1 with Reflection 1.  As we dey prepare for this new year, we dey invite you make you join us throughout the coming year to think deeply every day about God Mercy wey full ground.  We also dey invite you make you invite family and friends to join us for this journey!  Invite them to join us through these ways:

  1. Signing up for emails wey dem go receive every day about Divine Mercy
  2. Installing our Catholic Daily Reflections app
  3. Visiting our website every day
  4. Buying Reflection for Every Day on Divine Mercy as paperback or eBook

Share God’s mercy wey plenty well-well with family and friends this new year!