Nigerian Pidgin

Di Way Jesus Dey Draw People to Himself 

January 14, 2022
Friday for First Week for Ordinary Time
Readings for Today

Video

Listen for English

When Jesus return to Capernaum after some days, people hear say He dey house.  Plenty people gather, sotey space no dey for dem again, not even near di door, and He preach di word to dem.  Mark 2:1-2

People wey dey come meet Jesus plenty sotey space no dey for everybody, not even near di door of di house wey He dey.  Dis situation fit make person think well.  If we look am for practical way, why Jesus no notice dis problem and do something about am?  Why He no move go open place wey big pass, where everybody go fit see Am and hear Am?

E hard to answer dat question, but one thing dey wey we fit dey sure of.  We fit dey sure say people wey come listen to Am, even if dem no fit enter, receive great reward for their faith.  Dis passage show us one very important spiritual truth.  E show say di deep spiritual desire to dey near Jesus, even by itself, dey change person.

Plenty times, we go experience something like dis.  We fit notice say we really want hear Jesus speak to us, but e be like say we no fit hear Am.  E fit be say e seem to us like He dey silent, or we no know where to find Am.  But no let your heart weak if na dis you dey experience.  Di truth be say your desire to dey with Am na great gift by itself, and e fit change your life.  

Today, think deeply about wetin we fit call “di silence of God.”  Some times fit dey for your life when e go seem say God dey far away and you no fit find Am anywhere.  When dis happen, make you understand say na one way God dey use call you to come even closer to Himself.  Na one way God dey use whisper so dat you go give Am all your attention.  If na dis kind “struggle” you dey experience sometimes, face our Lord with even more attention, and allow your desire for Am to grow.  Na dis desire to dey near Jesus fit actually bear much more fruit for your life than if you hear Am loud and clear.

My Lord wey dey quiet, abeg, make my desire to dey near You grow inside me.  Help me make I long for You with all my heart.  As I dey long for You, help me make I let go of everything wey no come from You and give You all my attention.  Jesus, na You I trust.

More Reflections on the Gospel

Reflection Dem about God im Mercy

Meditations on Scripture for Ordinary Time

Saints/Feasts for Today

Options for Mass Readings

Picture wey we feature above: Crowds gather as Christ dey heal sick people. Na T. Phil make this engraving, through Wikimedia Commons


Book Wey We Feature:

Daily Reflections for Ordinary Time:
Weeks 1-17

Reflections for Every Day for Ordinary Time: Weeks 1–17 from the Catholic Daily Reflections Series na devotional book for every day wey get reflections on the Gospel of the day, for way wey person fit practise, wey remain faithful to the faith, and wey connect with everyday life.  Dem arrange the eBook and paperback versions so that person fit use this book year after year. The reflections no get specific dates for Ordinary Time 2022; instead, dem cover every option for this liturgical year and the ones wey dey come, so person fit use this devotional book from year to year.