July 28, 2020
Tuesday for the Seventeenth Week for Ordinary Time
Readings for Today

Listen for English
“Just as dem dey gather weeds burn them with fire, na so e go be when this age end. The Son of Man go send His angels, and dem go gather comot from His Kingdom everybody wey dey cause other people to sin and everybody wey dey do evil. Dem go throw them inside furnace wey fire dey burn, where dem go dey wail and grind their teeth. Then people wey dey live right go shine like sun for their Father Kingdom. Anybody wey get ear suppose hear.” Matthew 13:40-43
Think how that day go be! Imagine say na tomorrow be that day. If Jesus go return tomorrow to carry out complete justice for the world, you go still dey worry about any injustice today? E fit be say you no go worry. Instead, you go fit relax and get peace because you know say justice dey come.
Well, that day dey come soon. Na wetin Jesus talk be that. True, E talk am almost 2,000 years ago, but for Him, e still be soon. God dey look time from the angle of eternity. So, the end of the world dey real for God today just as e go be when e happen.
E good make we keep this one for mind when we see evil dey prosper and injustice dey increase. E too easy to vex and feel troubled because of the victories wey the wicked one dey get every day. But no fear and no worry. Na God truly dey in control. E know wetin E dey do, and na Him go get the final glorious victory over everything.
So think about that one. When Jesus return with all His glory and put everything right, the evil wey we dey endure now go still matter? In fact, if we look am from the angle of eternity, the evil wey we dey endure suppose only help us get holy endurance. God fit use all of am show His grace and strength for our lives.
Today, reflect on how things be from the angle of eternity. If you stand firm through everything now, and you dey try do so with patience and grace, you fit dey sure say all the struggle and everything wey you must endure go worth am for the end. For the new glorious Kingdom of God, you go get peace, and joy go fill your life forever. Dem go put every wrong right, and God go get victory. Make sure say you get “ears to hear” this truth, and hold am tight through everything.
Lord, help me keep my eyes on You and Your final victory. Help me wait with patience for Your final victory and endure the evil for this world with the grace and strength wey You dey give me. Make I never forget the final promise wey You don tell me. Jesus, na You I trust.
More Reflections on the Gospel
Reflection Dem about God im Mercy
Image: The Last Judgment wey Pieter Paul Rubens paint





