Thursday, August 6, 2020
Feast of the Chanjin Kamanni of the Lord, August 6

Listen for English
Jesus take Peter, James, and John wey be James brother, carry dem go up one high mountain where na only dem dey. For their front, Im kamanni change, and Im clothes come dey shine bright white, white pass wetin anybody wey dey wash cloth for this world fit make dem be. Mark 9:2-3
You dey see the glory of God for your life? Many times, this one fit really hard. E easy make we notice all the problems wey we dey face and put all our mind on dem. Because of this, e often easy make we fail to see the glory of God for our lives. So, you dey see God glory for your life?
The feast wey we dey celebrate today na to remember how Jesus truly show Im glory to three of the Apostles. E carry dem go up one high mountain, and Im kamanni change for their front. E come dey shine bright white, and glory dey radiate from Am. This na important picture wey dem need to keep for their mind to prepare dem for the real suffering and death wey Jesus dey about to pass through.
One lesson wey we suppose learn from this feast na say Jesus no lose Im glory for the Cross. Na true say Im suffering and pain show clear that time, but that one no change the fact say Im glory still real just as before, even as E dey suffer for the Cross.
Na so e still be for our lives. God don bless us pass wetin we fit measure, and E still dey desire to change our souls into glorious lights wey dey shine with light and grace. When E do this one, we must try hard to dey always see am. And when we dey suffer or face any Cross, we must never take our eyes comot from the glorious things wey E don do for our souls.
Today, tink deeply about the beautiful change wey get deep meaning wey God don bring and still dey desire to bring for your soul. Know say E want make you fix your eyes on this glory and always remain grateful for am, especially as you dey bear any cross wey dem give you.
Lord, make I see Your glory and the glory wey You don give my own soul. Make my eyes always remain fixed on that grace. Make I see You and Your glory, especially for difficult times. Jesus, na You I trust.
More Reflections on the Gospel
Reflection Dem about God im Mercy
Saint of the Day – Chanjin Kamanni of the Lord
Picha: Chanjin Kamanni wey Titian paint




