Nigerian Pidgin

To Show Your Love for God

March 29, 2021
Monday for Holy Week
Di Readings for Today

Video

Listen for English

Then Judas Iscariot, one of His disciples, and di one wey go betray Him, talk say, “Why dem no sell this oil for di pay of three hundred days work, come give di money to poor people?” John 12:4–5

Jesus dey with His disciples for di house of Lazarus, Martha and Mary. E dey spend time for their house regularly, and E close to dem. Dem chop this food just before Jesus enter Jerusalem for di first Palm Sunday and Holy Week. Na six days remain before Jesus go die for cross.

Remember say Jesus don recently raise Lazarus from death. Remember too say Mary, Lazarus sister, get deep devotion to Jesus. Scripture record say na she sit down for His feet while her sister Martha dey serve. During this visit, Mary show her devotion to Jesus again as she anoint Him with “one litre of costly perfumed oil.” Na act of love and devotion she offer Him. Di Scripture passage above record wetin Judas talk, as e too dey for di meal. Jesus rebuke Judas and defend di act of devotion wey Mary offer, and dem continue di meal. 

One clear lesson wey this one teach us be say nothing too good for our Lord. Na true say we must do our part to help care for poor people, but Jesus answer to Judas really make person think. E talk say, “Leave her alone. Make she keep this one for di day of my burial. Poor people dey with una always, but I no go dey with una always.” Jesus no dey talk say to care for poor people no important; E dey stress how e important to offer Him acts of love and devotion.

As we enter this week wey holy pass every other week for di year, we see this picture of Mary as she generously pour this one litre of costly perfumed oil on Jesus. This na invitation for us to do di same. Even though we dey serve Christ through other people wey dey in need, we must still make effort to dey offer Him devotion and love directly, even for ways wey other people fit think say e too much. To honour Him, to show our love, to spend time on different devotions, to pray for long periods, and even to offer Him our money—na all these be ways wey we dey give Jesus di glory wey belong to Him.

Today, think well about ways wey you fit imitate this act of loving devotion wey Mary offer Jesus. For which ways you fit generously pour out your time, money, talents and strength for our Lord? How you fit best show your devotion to Him this Holy Week? Find ways to do this directly for Him, just for this one simple reason: you love our Lord and you want show that love this week.

My Jesus wey full of glory, You deserve all praise and honour. You deserve our deepest devotion and love. As I enter this Holy Week, I pray make e be time wey I go fit show You my deepest love. Help me to pour out that love well-well this week, so I go give You di glory and praise wey You deserve. Jesus, na You I trust.

40 Days for the Foot of the Cross – Reflection Forty – The Silence for the Tomb

Resources for Lent

Prayers for Holy Week

More Reflections on the Gospel

Reflection Dem about God im Mercy

Scripture Meditation Dem for Lent

Saints/Feasts for Today

Options for Mass Readings

Di main picture above:  Di Ointment of Magdalene, wey James Tissot paint