Tuesday, October 1, 2019
Tuesday for di Twenty-Sixth Week for Ordinary Time
Saint Thérèse of di Child Jesus, Virgin and Doctor – Memorial

Listen for English
“Lord, You want make we call fire down from heaven make e burn dem finish?” Jesus turn rebuke dem, and dem continue their journey go another village. Luke 9:54-56
Dis words wey James and John talk na wetin plenty people dey feel like to talk for different times for their life. Maybe you don feel like dis too. Dis Apostles talk like dis because people no welcome Jesus for one Samaritan town wey dem just enter. E want chop there, but di people for di town reject Am and His Apostles. Because of dis, James and John feel hurt and vex, and dem want call down God wrath upon dat village.
Anytime person hurt us for life, we fit understand why we dey feel like dis. We dey want justice and revenge, and we want make di people wey hurt us pay for their sin. But Jesus own attitude different well-well. E rebuke His Apostles because dem want make wrath come upon di people, and E continue His journey without allowing di rejection to affect Am.
E fit hard to let go when people reject us or hurt us for other ways. Di hurt fit easily remain for our heart, like mould wey dey grow small-small until e take over everywhere. When dis happen, e fit hard well-well for you to forgive and let go of di hurt.
Di best way to handle di hurt wey another person cause na to do wetin our Lord do straight away. You must let go of am immediately and continue with your life. Na only God get right to take revenge, no be we. When we no do dis, but keep di hurt for our heart, e go later harm us pass any other person.
Today, think deeply about any anger or hurt wey you still keep for your heart. Make up your mind to forgive and continue with your life. To forgive no mean say you go behave as if di wrong wey dem do you no bad. Instead, when you forgive another person, you still dey acknowledge say dem do wrong. Forgiveness dey help you stop dat hurt from causing you more harm wey no necessary. For di end, e still be open invitation for di other person to repent and reconcile with you. Leave revenge and wrath for di Lord, and try keep your heart for peace.
Lord, I dey pray for di grace to forgive. I especially forgive di people wey don hurt me pass, and I dey offer dem to You. Free me from any feeling of revenge wey I dey keep for my heart, and help me to love with Your pure heart wey full of mercy. I love You, dear Lord. Help me to love other people as You dey love. Jesus, na You I trust.
More Reflections on the Gospel
Reflection Dem about God im Mercy
Saint for Today – Saint Thérèse of di Child Jesus
Wetin We Fit Learn from Saint Thérèse:
Di Wisdom of God Little Flower
Amazon Paperback – Amazon Kindle – Google Play – iTunes – Barnes & Noble





