August 27, 2020
Thursday for di Twenty-First Week for Ordinary Time
Readings for Today

Listen for English
“Make una dey awake! Because una no know di day wey una Lord go come.” Matthew 24:42
What if na today be dat day?! What if you know say na today our Lord go return to di world with all His splendour and glory to judge di living and di dead? You go change how you dey behave? E likely say all of us go change. We fit contact as many people as we fit reach, tell dem say di Lord go soon return, go confession, and then spend di day for prayer.
But wetin suppose be di best response to dis kind question? If God, through one special revelation, make you know say na today di Lord go return, wetin suppose be di best response? Some people don suggest say di best response na to carry on with your day as you go do any other day. Why? Because as e suppose be, all of us suppose dey live every day as if na our last day, and dey follow wetin di Scripture above talk every day. Every day, we dey strive to “dey awake” and dey ready for our Lord to return any moment. If we truly dey accept and live by dis Scripture, then whether He return today, tomorrow, next year or many years from now no make any difference.
But dis call to “dey awake” no concern only di final coming of Christ in glory. E still concern every moment of every day wey our Lord dey come meet us through grace. E concern every way wey His love and mercy dey move our hearts and souls. E concern di gentle whispers wey He continually dey use call us to come closer to Himself.
You dey pay attention as He dey come meet you in all dis ways every day? You dey pay attention to di countless ways wey He dey seek to enter your life more fully? Even though we no know di day wey our Lord go come in His final victory, we know say every day and every moment of every day na moment wey He dey come through grace. Listen for His voice, pay attention, dey watch and dey awake!
Lord, help me to seek Your voice and pay attention to Your presence for my life. Make I continually dey awake and ready to hear You when You call. Jesus, na You I trust.
More Reflections on the Gospel
Reflection Dem about God im Mercy
Saint of di Day – Saint Monica



