Nigerian Pidgin

Di Lord na King

November 27, 2020
Fraide for di Thirty-Fourth Wik for Ordinary Time
Readings for Today

Listen for English

“…make una know say God Kingdom don near.”  Luke 21:31b

We dey pray for dis every time we pray di “Papa We” prayer.  We dey pray say, “Make Your Kingdom come.”  You really mean am when you pray like dat?

For dis Gospel passage, Jesus talk say God Kingdom don near.  E near, but plenty times, e still dey very far.  E near for two ways.  First, e near because Jesus go come back with all Im splendour and glory, and make everything new.  Na so Im Kingdom wey go last forever go take stand.

Second, Im Kingdom near because na just prayer remain for am to come.  Jesus dey really long to come establish Im Kingdom inside our hearts, if only we go let Am enter.  Sadly, plenty times, we no dey let Am enter.  We dey often keep Am far from us, and our mind and heart dey go front and back as we dey wonder whether we go enter fully into Im holy and perfect will or not.  Plenty times, we dey hold back from accepting Am fully and allowing Im Kingdom to stand inside us.  

You know how near Im Kingdom dey?  You know say na just prayer and decision from your own will remain?  Jesus fit come meet us and take charge of our lives if only we go allow Am.  Na Im be di King wey get all power, wey fit change us into new creation.  E fit bring perfect peace and unity to our soul.  E fit do great and beautiful things inside our hearts.  We only need to talk am, and really mean am, and E go come.

Today, think deeply about how Jesus heart dey long to come meet you and establish Im Kingdom for your life.  E dey long to be your Ruler and King, and to rule your soul with perfect unity and love.  Allow Am come establish Im Kingdom inside you.  

Lord, I invite You to come take my soul as Your own.  I choose You as my Lord and my God.  I surrender control of my life, and with my own free will, I choose You as my God and divine King.  Jesus, na You I trust.

See our materials for Advent!

Deep Reflection on Scripture

More Reflections on the Gospel

Reflection Dem about God im Mercy

Saints/Feasts for Today

Options for Mass Readings

Special picture wey dey up: Mosaic (Jesus) from Hagia Sophia