July 2, 2020
Thursday for di Thirteenth Week for Ordinary Time
Readings for Today

Listen for English
When Jesus see dia faith, E tell di man wey get paralysis, “My pikin, get strong mind; I don forgive your sins.” Matthew 9:2b
Dis story end as Jesus heal di man wey get paralysis and tell am make e “get up, carry your stretcher and go house.” Di man do exactly so, and surprise catch di crowd.
Two miracles happen here. One na for body, and one na for spirit. Di one for spirit na say di man receive forgiveness for im sins. Di one for body na di healing of im paralysis.
Which of dis two miracles dey more important? Which one you think say di man want pass?
E hard to answer di second question because we no know wetin dey di man mind, but di first question easy. Di spiritual healing, wey be di forgiveness of im sins, dey far more important pass di other miracle. Na im matter pass because wetin e do for im soul go last for eternity.
For most of us, e easy to pray to God for things like healing for body or other things like dat. E fit easy well-well for us to ask God for favours and blessings. But how easy e be for us to ask for forgiveness? Dis one fit hard pass for plenty people, because e require make we first humble ourselves. E require make we first admit say we be sinners wey need forgiveness.
To admit say we need forgiveness require strong mind, but dis strong mind na great virtue, and e show say our character get great strength. To come meet Jesus to seek Im mercy and forgiveness for our lives na di most important prayer wey we fit pray, and na di foundation for all our other prayers.
Today, think deeply about how much strong mind you get to ask God for forgiveness, and how you dey willing to humble yourself and admit your sin. To humble yourself like dis na one of di most important things wey you fit do.
Lord, give me strong mind. Give me strong mind, especially to humble myself before You and to admit all my sins. As I dey humbly admit dem, help me make I still dey seek Your forgiveness every day for my life. Jesus, na You I trust.
More Reflections on the Gospel
Reflection Dem about God im Mercy
Picture: Christ dey heal di man wey no fit waka for di pool of Bethesda, by Peter van Lint




