October 29, 2020
Thursday for Week Thirty for Ordinary Time
Readings for Today

Listen for English
Some Pharisees come meet Jesus come talk say, “Comot, leave this area because Herod wan kill You.” Jesus answer dem say, “Go tell that fox, ‘See, I dey drive demons comot and I dey heal people today and tomorrow, and for the third day I go complete wetin I come do.’” Luke 13:31-32
This talk between Jesus and some of the Pharisees really get wetin we fit learn from am. E good make we look both wetin the Pharisees do and wetin Jesus do.
Person fit ask why the Pharisees talk to Jesus like this, as dem warn Am about wetin Herod plan to do. Dem dey worry about Jesus, and na why dem dey try help Am? E no likely. Instead, we know say most of the Pharisees dey jealous Jesus and dey envy Am. For this matter, e be like say dem dey warn Jesus about Herod anger because dem wan put fear for Im body so that E go leave their district. But Jesus no let dem frighten Am.
Sometimes, this same thing dey happen to us. Sometimes, person fit come tell us gossip wey people dey talk about us, come pretend say na to help us, when the truth be say na hidden way to frighten us and fill our mind with fear or worry.
The main thing na to respond only as Jesus respond when E face foolish behaviour and bad mind. Jesus no let their attempt to frighten Am control Am. Herod bad mind no worry Am at all. Instead, the way E answer show the Pharisees something like this: “Make una no waste una time to try fill My mind with fear or worry. I dey do My Father work, and na only that one I suppose concern Myself with.”
Wetin dey worry you for life? Wetin people dey use frighten you? You dey allow wetin other people think, their bad mind or their gossip to discourage you? Na only to do wetin the Father for Heaven want we suppose concern ourselves with. When we dey do wetin E want with confidence, we go also get the wisdom and courage wey we need to stand against all deceit and foolish ways wey people dey use try frighten us for our life.
Today, think well about how you don commit yourself to do wetin the Father want for your life. You dey do wetin E want? If na so, you don notice say some people dey come try stop you? Try your best to get the same confidence wey Jesus get, and keep your mind on the mission wey God give you.
Lord, I truly trust Your divine will. I trust the plan wey You don arrange for me, and I no gree make other people foolish behaviour and bad mind control me or frighten me. Give me courage and wisdom to keep my eyes on You for everything. Jesus, na You I trust.
Prayers & Resources for the U.S. Elections
More Reflections on the Gospel
Reflection Dem about God im Mercy




